Friday 1 November 2013

Conversation as it was captured and reported by a Yoruba fly on Stella Odua’s living room wall .

Stella: Old girl , how you dey ? 
Friend: I dey O! People wan chop you raw because of two small cars . 
Stella: No mind them, I chop pass my two female colleagues, the skinny one and the fat cheek one ? 
Friend: You think say na them set you up ? 
Stella: Who know ? Them too don dey avoid me, I flash them , no answer, I ping them, them no ping back, I BB them, for where ? . 
Friend: Wetin Oga on top talk ? 
Stella: He say make I relax becos he dey behind me like Iroko tree . He even say make I no go for the hearing, but I go there ,I show those little men my power nothing go happen, you know say their oga balls dey my pocket . 
Friend: Wetin you wear go for the hearing, you show them those curves ? laughter… 
Stella: I wear that Tie dye suit wey you give me for my birthday with matching head tie. 
Friend: Wetin your ex-husband talk about all this wahallah ? 
Stella: He say na God catch me . 
Friend : You go resign ? 
Stella: For where ? God forbid , You ever hear say Oba go transfer ?.. Laughter 
Friend : You dey read the things wey dem dey talk about you for punch ? 
Stella: I no dey read that Yoruba newspaper 
Friend: Your Ibo brothers and sisters dey fight for you there O! 
Stella : Make them dey fight for me , wetin them know ?..mugus. 
Stella: Chukwudi !!! Come kill this fly for wall… 
FLY.. Oh crap !!!… gat to go!!!!! 
That was when the house boy sprayed it with insecticide and the fly managed to fly in to file this report , he is recovering in a local hospital

No comments:

Post a Comment